Table of Contents
Zanzibar Commission for Tourism dey investigate Zainab Oladehinde sexual assault claim wen she spend vacation inside Warere beach hotel.
Zainab, na Nigerian lady wey become guest of Warere beach hotel in April 2021 to mark her 23rd birthday but e become a sad experience, according to her.
For series of Twitter thread Zainab Oladehinde post on Saturday, she tok about di attack wey she experience wen she enta Zanzibar to holiday.
Warere beach hotel for Zanzibar don also reply Zainab Oladehinde, just read on for di full gist.
Zanzibar na semi-autonomous territory (wey mean dem get dia own president but dey use Tanzania money) wey dey political union with Tanzania.
And one of dia major source of income na tourism.
Zainab Oladehinde tweet about her Zanzibar hotel experience
“Few hours into my sleep (on my birthday), I start to feel strange hand dey touch my breast.” Zainab Oladehinde post thread for Twitter.
Di Nigerian lady describe her experience as traumatic, as she say she bin need therapy afta wetin happun.
Zainab suppose spend six days for di Warere Beach Hotel for Zanzibar wen di incident happun.
And she say she travel all by her sef for dis trip, despite all her fears.
“Now dis na me wey bin dey sleep naked for my hotel room wey di door bin dey locked,
“So I bin tink say na dream. Na wetin I tell my self before I sleep back”.
She go into detail as to how a few minutes later, di strange man wey enta her room, start to dey use her hands to please imself – touch im penis.
Na dat moment she wide her eyes to see weda true-true she dey in danger, di lady tok.
Zainab recount as di strange man wey enta her locked room bin wan climb her before she come lie give am say she get HIV as she dey cry.
Na so di strange man start to dey strangle am, then “as I dey struggle so e no go strangle me, na im e comot di room say e go come back with condom”. She tok for di tweet thread.
Afta dis incident, she add say she come find out say apart from di attempted rape, dem bin steal di $1,100 wey she keep for bag.
Zainab come recall how she run leave her room, to enta di room of one Russian couple wey she bin make friends with di day before.
Di male Russian even gree to do video to verify di events.
She tok say, she report di mata to di hotel owner, and even go police station wia dem throw am out say, no body rape am.
Warere beach hotel Zanzibar reply Zainab Oladehinde
Warere beach hotel Zanzibar release statement wey dem also admit say di mata enta go through di Zanzibar Nungwi police.
Di hotel add say di mata bin also pass through di District Commissioners Office, Regional Commissioners Office.
And di office of di Second Vice President of di goment of Zanzibar hear wetin happun, afta which Zainab no gree move di case further. Dem add.
Warere Beach claim say “di police report bin show say di mata na personal case, and no be say Warere bin dey negligent”.
Dem bin add say, “We tell Zainab Oladehinde say di hotel go abide by any damages wey di court system for Zanzibar rule.”
Dis na as dem hala on top di negative reviews wey dem don receive by pipo wey neva visit di hotel before.
Warere beach hotel reviews
Warere beach hotel Google rating don drop from 4.5 to 1.2.
Di Warere beach hotel reviews drop within hours afta @zanaibdehinde tweet her experience.
Zanzibar Commission for Tourism reaction
Commission for Tourism for Zanzibar don release dia own statement say dem don start to investigate di mata.
Di Commission say “We dey shocked and disappointed to learn about dis mata and dey take di allegation very seriously”.
Dem promise say dem go report on di findings of dis investigation.
Dem condemn any harm or threats to visitors to di “peaceful islands of Zanzibar”.
Twitter users react to Zainab Oladehinde alleged assault for Warere beach hotel Zanzibar
Zainab Oladehinde sexual assault claim, plenti pipo don dey recount dia experiences for Zanzibar hotels dem.
Some pipo recount dia experiences from oda hotels dem for Zanzibar.
But all of dis reactions na claims wey BBC Pidgin no fit independently verify at di time of dis tori.
While odas give advice on wetin to do next time.
Head of Nigeria in Diaspora Commission don chook mouth for di mata.
Abike Dabiri-Erewa for statement say she go escalate di mata give di Tanzania High Commissioner to Nigeria.